OUR GOD NO GO SHAME US

avatar

I no say them don try see whether we go cry
But, the thing be say Oluwa no fit shame us
Even say money no dey for our purse
That one e no means say everything dry
Papa God tell prophet Ezekiel say
You feel say this bones fit live again?
Ezekiel yan say him no sabi
Him talk am say na you Papa wey dey sabi
And as the all knowing Papa wey you be
You come direct am mek him yan the bone
Unto the phophet wey him be
Ezekiel come arrange peperistic prophesy

Asthe matter come dey go,
na him bone come arrange himself well
flesh take enter flesh
blood kak well for the blood level
So final final dry bone don turn to life oo
Na the matter be that
Shebi you sabi say such thing no fit happen
But God take style arrange this miracle
so that make them no shame us

Broda mmi
Make you kpom kpi
Our God wey we serve NO GO SHAME US
No, him no fit shame us
Even say we go astray,
Him no fit leave nor forsake us
Beacause as he no abandon the dry bones for valleys
I believe say Him go tanda solve all ya matter,


Thank you for reading this pidgin version

Abeg mek you show back tomorrow for another orisiri yan
IMG_20200209_131452.jpg

Na me dem dey call @voclab

Una Weldon



0
0
0.000
0 comments